+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Malawi Don Start To Find Dem VP Wey Lost With Helicopter

Dem don start to look for di military helicopter wey karey Malawi Vice President, Saulos Chilima join with nine pipo inside di plane wey lost.

According to President Lazarus Chakwera foma first lady Shanil Dzimbiri, 51 years VP Chilima and eight pipo nai travel from di capital of Lilongwe to go di burial of one foma govimet minister wey die but afta 45 mins di helicopter never still land for Mzuzu International Airport.

Like dis sojas don dey find di forest for Northern Malawi to know where di plane fall put on Monday.

As President Chakwera dey tok, he say di air traffic control tell di pilot make dem nor land for ground cus di weather nor good so e go beta make dem turn back but bifor dem close ete open am dem nor fot dey hear anytin with di plane again.

Chakwera don dey beg Malawi pipo make dem dey pray for those wey dey di plane and deme family members.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM