Actress Patience Ozokwor, aka Mama G, don say she go karey one widpw and di pikin to court cus dem dey lie for her head about land mata.
One video of di widow and her dauta waka for social media say di only land wey di woman husband leave for her bifor she die nai Mama G go buy by force.
Plenty pipo don dey tok about di mata bifor Mama G come out make pipo hear her side as she buy that land for 2010.
Mama G say na di widow nai go meet her agent to look for pesin wey go buy land nai dem see for her but walaha start for 2024 wey she hear say di widow don go sell one part of di land.
As she hear, nai she go fence di land but now di mama and di dauta dey cry say na force she take di land from dem.
Patience on Tuesday come say all wetin dey hapun na just cheap blackmail to spoil her name and she nor go allow any bodi try am cus na court dem go reach.