+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Man Kill Girlfriend and Dauta For Edo State Afta Quarrel

Argument between one Wealth Nnamdi and hin babe Osasu Isaac don make dem teree years relationship lead to kpufnes of mama and pikin on di 16 of March inside Edo State.

‎According to neighbors wey dey for Idiangbona Street for Ovbiogoe community wey di two pipo dey stay, say Wealth pack dey follow Osasu dey stay with her teree years girl pikin but di two of dem na cat and rat for quarrel.

‎Dem say di two don dey plan traditional marriage God March 29th as Osasu don already get belle and she dey very happy but wey dem start to quarrel on Sunday di neigbor come think say na dem normal way don start again.

‎But afta di quarrel finish dem not hear any noise again till afta two days wey smell start to dey come from di couple room, nai dem call police.

‎Wey di Police Public Relations Officer for Edo State, Moses Yamu, dey tok hin say na officers from Ekiadolor Division nai go force di door open wey di neigbor call dem only to see di woman deadi bodi for ground with cutlass cut for her head and di dauta deadi bodi on top bed.

‎Benin police say dem don already start to find Wealth Nnamdi as na him be di nuba one suspect.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM