+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Man Wey Dokitors Give Pig Kidney Don Laslas Die

E never reach two months wey dokitors for Massachusetts General Hospital karey pig kidney go put for one 62 years man bodi for United States of America.

Mata now be say Rick Slayman wey dey suffer of kidney disease don laslas die afta di surgery.

Di man don bin dey suffa of end-stage kidney disease till March wey dokitors come karey pig kidney wey dem don komot sumtins to make am fit stay for human bodi and still epp make pipo wey get kidney nor dey waka find kidney again. All to make di pesin still get life.

But on Sunday nai di family of di 62 years man come out to tok say dem broda don die and say di hospital dem try dem best.

Wey di hospital dey tok About di man mata, nai dem say as Slayman die e pain dem but wetin dem know say nor be di pig kidney nai make am die.

But as di man don make dis bold step e go stand as hope for pipo wey  get kidney problem and wan go do dat kind surgery to epp dem stay alive.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM