+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Man Wey Kill Papa For Oil Field Road, Police Don Catch Am

‎On Thursday 21 of August nai one Ifeanyi wey dem dey stay for Oil Field Road go use cutlass finish he papa wey be Sunny like meat wey dem wan sell.

‎Police for Enerhen come arrest Ifeayin on Sunday for one hotel wey he dey flex with two girls afta he don do birthday party for one with di money wey he tiff from di papa bifor he run.

‎Wey hand don touch am thru di neighbors wey start to find am cus afta he go kill di papa for sleep that Thursday nai Ifeayin run with money wey di papa take sell land.

‎Na there he come dey confess say na he cult pipo nai tell am to kill he papa so as di neighbors come hear di way di papa dey cry that nite dem come rush di papa with blood to hospital but di man nor survive am.

‎Delta State PPRO Bright Edafe never tok about di mata of Mr. Sunny but dem don put di deadi bodi for mortuary.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM