+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Max Airoplane Tyre Bust, Investigation Dey Go On

A Max Air aeroplane wey karey 119 passengers plus di 6 crew members wey dey travel from Yola go Abuja airport on Sunday nai tyre burst as dem dey ready to fly.

Statement from di Director of Public Affairs and Consumer Protection of Nigerian Safety Investigation Bureau, Bimbo Oladeji, say na around 11:22 for nite nai di accident take hapun but di good news be say nor bodi die or injure.

Dem say na two tyre nai first bust when dem don clear di plane to fly and e just dey run for di runway bifor dem hear anoda sound, di other two tyres don bust.

Dis morning nai NSIB Director General, Captain Alex Badeh lead some team make dem go check wetin really cus di tyres to bust.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM