Di highest court for South Africa don say any man wey like to change he name to di wife papa name fit do am freely and notin go stop am.
Dis na afta two different couples: Jana Jordaan and Henry Van Der Merwe, and Jess Donnelly-Bornman and Andreas Nicolas Bornman for March karey di mata first go di lower court bifor dem reach di highest court.
Van Der Merwe say he wan ansa di wife papa name Jordaan, then Bornman say he wan he wan ass he wife papa name Donnelly join he own name but dem nor gree am, nai make dem karey mata to court.
As di two couples come stand to fight di section of di Free State Division for High Court, dem win go make oda court start to follow dis new rule and di Birth and Death Registration Act for di kontri, Parliament get to change am to fit di new order.