+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Men Wey Dey Disturb Ughelli With Cult, Tiffing, Hand Don Touch Teree

Teree pesin wey dey waka upandan dey disturb di peace of Ughelli and some other places nai Delta State Police Command don catch for different locations.

Dem caught one for Ughelli on May 24, he name na  Emmanuel John Aisewowhion, and him na member of Aye cult and di gun wey police see for he hand he say na one Goodluck Sakutu wey dey run nai give am.

Di other pesin na Philips Omomedia, as pipo don dey complain say hin dey disturb Onogo-Vor community for Ughelli with cult problem.

Omomedia na Aro-Bagar cult member, and he don fall many pipo for di area. By di time police arrest am dem see one automatic double-barrelled gun with 15 live cartridges from am.

Then di last pesin na for along Oputu Road, for Orhwhorun community for Udu LGA, nai dem take catch Christopher Semede.

Hunter dey road dey do stop and search dem stop one Okada man and passenger but dem come dey run, n from porchu nai dem take catch Semede wey be 33 years come see one local double barrel pistol for he hand.

DSP Bright Edafe, PPRO of Delta State Command, say di teree of dem dey custody and go soon land for court afta dem finish investigation.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM