+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Men Wey Get Power For Abuja Dey Ask Court To Free Bandits – Gov Lawal

Govinor Dauda Lawal of Zamafara State don dey accuse some big men wey dey Abuja say na dem dey enta di state to cus problem.

Na wey him deg swear in di new magistrates for Gusau di capital of Zamafara nai he take tok so and dey urge di lawyers make dem folow wetin di rule of law don already put for dem.

Di Govinor say some of di judiciary dey try but some nor get head and tail cus dem catch some bandit leaders with different weapon but pipo wey get power for Abuja tell court to free di bandits.

Since dem arrest di bandits naso call di big men for Abuja dey call dem make dem relax say dem go come out, bifor you know dem give order from Abuja make court free di bandits.

As di new judges dey enta position naso Gov Lawal come dey tell dem make dem get sense and serve well for di good of di state and not for any big man.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM