+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Minister Of Labour Dey Beg NLC and TUC Make Dem Consider FG Ontop Minimum Wage

Di way dis new minimum wage tok dey go upandan with Federal government and organized Labour nor just dey make sense cus e never clear where di wage go really face.

Remember say na N48K nai FG first say dem fit pay bifor dem come karey am go N54K untill yesterday wey dem say na N60k dem go pay na so NLC and TUC vex waka troway seat komot from di meeting.

As di of NLC, Joe Ajearo dey show he provocation, he say di govimet nor just get workers interest for heart at all, cus how dem go call that kind price for National minimum wage wey tins hard like stone.

But for statement wey di Minister of Labour, Mrs Nkeiruka Onyejeocha bring out on Wednesday afta di meeting with FG and Labour nor get head, nai she come dey beg NLC and TUC make dem take tins easy with govimet.

Wey she dey tok thru di mouth of Mr Olajide Oshundun, Director of Press and Public Relations for di ministry, nai Onyejeocha take say FG dey try Dem best to work sumtin out but make Labour still know say tins nor easy for govimet as di kontri dey try to bounce back afta Covid and some other problem.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM