+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Mr Macaroni Don Dig President Tinubu Old Tweet Against Jonathan

‎Skit maker, Adebowale Adedayo aka Mr Macaroni don give President Bola Ahmed Tinubu gbasgbos from same word wey he tok for Twitter for 2014.

‎Di comedian go dig wetin Tinubu tell foma President, Goodluck Jonathan word for word and instead of am to put PDP na APC head karey am.

‎Some of di tweet wey Presidio Tinubu write that time for 2014 dey condem di state of economy, how christians take dey die anyhow for church wey dem go and security problem.

‎N there nai Macaroni turn table put for APC head as he use di same word wey Tinubu tok for di tweet take tell am back from “Di way dem dey kill Christian pipo for church na really bad tin. Dem get to ask Tinubu kwestun weda he for protect Nigerians.

‎“Nigeria security situation don worse and di kontri pipo don tire for explain. Dem want real protection.”

‎”Di whole kontri nor trust APC again. Di way tins dey go pesin just nid to shine eye.”

‎All di tins wey Macaroni write na from President Tinubu from 2014 and di mata wey he go dig don dey cus anoda problem for social media.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM