+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

MTN Open Pipo Line Wey Una Block — NCC

Nigeria Communications Commission, NCC, don shout for MTN Nigeria ear make dem sharply go open pipo Sim wey dem block on Sunday.

Na on Monday na NCC thru dem Director of Media and Public Affairs, Ruben Muoka, take send di message give MTN.

Di whole mata start on Sunday after pipo wey dey use MTN line nor fit make call again as di network don baned dem say dem nor link their NIM to dem SIM line.

As MTN do dem disco nai pipo gada dem office on Monday dey struggle how dem line fit come back to life.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM