+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

N500 Fuel Subcharge Go Hapun But No Be Now

‎Di Chairman wey dey in charge of Presidential Tax Reform Committee, Taiwo Oyedele, say make pipo relax dem mind concerning di January 2026 fuel subcharge of N500 wey govimet wan dey kolet as di time still far.

‎Tok don dey on upandan about how govimet wan make pipo dey pay N500 any time wey dem buy fuel, nai cry don dey start say na anoda round of suffanes nai dey shine eye dey look.

‎But wey Oyedele come dey explain di mata for he pipo just dey tok wetin never hapun as di Federal Emergency Agency (FEMA) Act never tok weda dem go put di subcharge or not.
‎A
‎He tok for video say di law dey for FEMA Act but dem never tok weda e go hapun for January 2026 but na future e go hapun if di Minister of Finance give order and di Minister nor go karey just put di law now.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM