+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Na $5M NMDPRA Oga Spend For Children Secondary Skool Fees—Dangote

Chairman of Dangote Group, Aliko Dangote, don bust everywhere with wetin Ahmed Farouk, di CEO of Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority (NMDPRA), dey do with public moni.

Di billionaire first accuse di NMDPRA boss say na wayo pesin and he eye dey use public moni train he children on Monday, wey hin do press meeting cus of di wahala wey dey around buy fuel for Nigeria or buy fuel from abroad.

Nai Dangote set fire say di four children of Ahmed na moni wey dem go use pay a whole generation skool fees nai he karey take pay for he children wey be Faisal Farouk, Farouk Jr., Ashraf Farouk, and Farhana Farouk for six years for Switzerland, and na for only secondary skool.

Dangote say na $5 million nai be wetin di NMDPRA CEO use for only secondary skool and even give details of di name of di skool as Montreux School, Aiglon College, Institut Le Rosey, and La Garenne International School.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM