+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Na Bad Politician Wan Just Spoil My Good Work For Kaduna, El-rufai

Di House of Assembly for Kaduna bin set up panel for April say make dem check di past govimet of Nasir El-rufai cus of some kind woruworu wey dem notice for he administration.

Nai dem come out 13 member ad hoc committee wey Henry Zacharia come be di chairman, nai dem open up say since 2015 to 2023 wey foma givinor El-rufai dey fo position moni wey ge kolet he nir use am for wetin supose use am for.

As di House dey on Wednesday for dem meeting na there Zacharia take say some of di project wey di foma . do nor follow di right process and even commisoners and officials wey dey di foma govimet their hand nor still clean.

But wey El-rufai come dey tok thru he tokpesin, Muyiwa Adekeye, he say di House committee nor know wetin dem dey tok cus na just bad belle nai everytin dey show.

Di foma Govinor say h work well to epp Kaduna state and di report of di committee na just kwashiorkor tok wey up dey try to bring just to spoil he name.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM