+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Na Kidnaper Tie Bomb For My Bodi To Go Rob UBA Bank

I nor be tiff, I be ND 1 student wey dey go skool around 9 for morning along Police Staff College Road bifor kidnaper tiff me yesterday.

Na wetin 17yrs Basil Benjamin tok as hin dey tell police afta dem arrest am with bomb as he dey try bomb one bank for Plateau state.

As police dey parade Benjamin join with other pipo wey commit crime for dem Command Headkwatas for Jos, nai di boy say na civil engineering he dey read for Plateau State Polytechnic bifor he find he sef inside dis mess of N100m wey kidnaper send am to to tiff for UBA bank.

He say wey dem catch am, he tok say he nor go fit go rob bank nai dey say if he nor go dem di kidnaper go kill am.

Dem come tie di bomb for him bodi and say wey he reach there make he tell di bank pipo say he gang dey outside dey wait for am with guns.

Benjamin come say na di kidnaper call okada Weg karey am go UBA for Dadinkowa. But as hin enta don tell di cash he mission and di cashier gree but bifor he know pipo come dey run, with fear he think say di kidnaper son enta to kill am, naso he run come outside.

Na for outside nai di security take catch am, see say na fake bomb dey he bodi.

Police commissioner for Jos say dem dey look di case to know weda di story na tru so that dem fit catch di kidnaper wey send am.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM