+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Na Students Wey Get Below 200 Nai Plenty Pass – JAMB

E be like say students nor go dey happy with di result of dem Unified Tertiary Matriculation Exams cus temper don already dey high for bodi.

Na yester nai di Registrar of Joint Admission and Matriculation Board, Prof Ishaq Oloyede come tok say di pipo wey get low score nai plenty pass.

For press briefing wey di board fo yesterday for Abuja nai Oloyede take say di students wey nor reach 200 nai plenty pass.

Know say na 1.9m students nai enrol for 2024 UTME but dem say some of dem nor come write di exam and 8,401 candidates nai fit 300 and above, then 77,070 just dey float between 250, come folow by 439,974 wey get 200 and above then di last set of  1,402,490 get 200 and below.

Di JAMB boss come still say dem sieze some students result cus of some kind woruworu wey dem notice inside and dem go do their own investigation to know how far.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM