+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

NAFDAC No Kolet Traders Moni By Trick or Wayo

‎Di video wey Martin Vincent Otse aka VeryDarkMan do with traders from Onitsha Bridge Head Market wey dem dey protest say dem close dem market and di moni wey National Agency for Food and Drug Administration and Control (NAFDAC) kolet from dem, no be true, according to di agency.

‎Di market pipo bin tok say NAFDAC by force kolet N700,000 from dem and VDM come even show one receipt wey di pipo take pay and he say na court nai NAFDAC go see.

‎But on Tuesday nai NAFDAC say wetin VDM dey tok no make sense and just dey use am cus problem wey even dey against cyber crime act.

‎NAFDAC come say di only moni wey dem kolet na penalty for wetin dem do and e follow normal federal govimet law.

‎Di mata start wey NAFDAC go teree open drug markets, shops, warehouses, and stores for Ontisha and see say dem dey go against di law of Good Storage and Distribution Practices.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM