NAFDAC don seize 277 carton of fake Malamal Fort anti-malaria mericin wey pass N1.2 billion for Lagos.
Na for one spare part warehouse for Ilasa-Oshodi nai dem take go hide di container of drugs put as em bring am from China, say na spare parts dey inside.
But wey di NAFDAC Director of Investigation and Enforcement, Dr. Martins Iluyomade dey tell tori pipo on Thursday for Lagos, nai he say as dem ship di goods reach Nigeria , for di port nai one of dem woman worker say she don dey suspect di container but to make her mind rest, naso she pass back follow know where dem karey di container go.
Iluyomade say dem hide di drug for carton of Diclofenac Potassium and na Shanxi Tianyuan Pharmaceuticals Group for China na produce am. Normally nobodi go suspect say na fake drugs cus of di packaging.
NAFDAC don go test di drug and dem say small investigation show say di pesin wey bring di drug come Nigeria na one man wey dey Onitsha bifor but run komot go China afta NAFDAC go ransak so drug market there.