+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

NANS President Don Beg Seyi Tinubu

‎For all di too many word wey dey komot from di National Association of Nigeria Students, (NANS) president mouth say Seyi Tinubu, son of President Bola Tinubu do, he don change am say na lie.

‎Atiku Abubakar Isah, don open mouth tok say Seyi Tinubu and di Minister for youth and sports development, Ayodele Olawande nai use N100 million take come bribe am to stand with President Tinubu but as he nor gree nai all di wahala start.

‎But Atiku mouth come change for Facebook, say wetin hapun for April 15th 2025, all na big lie.

‎He say na wrong information wey one Ladoja Olusola, give am nai say Seyi Tinubu send jaguda come beat and scatter di election and plus say Seyi not even near where di election for hapun.

‎Bifor now, Seyi Tinubu don make post for Instagram say all di tins wey Atiku dey tok na dust as na only for he dream di tin take hapun.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM