Singer Darlington Okoye, aka Speed Darlington, wey run mouth say he sleep with one small girl for hotel, National Agency for di Prohibition of Trafficking in Persons (NAPTIP) don call am to come ansa mata in pesin.
Na Lagos State Domestic and Sexual Violence Agency nai karey di mata go put for NAPTIP ear afta Speed Darlington dey tok for Instagram Live say he sleep with one 15 years girl for hotel.
Wey he dey even do di Live pipo don already dey vex for am for di word he tok and others come go dig out anoda video wey pipo dey drag am say he sleep with dem 16 years pikin.
As tok don dey waka too much for Speed Darlington nai he quickly do anoda video deg beg pipo say wetin he tok na lie, he just dey use am take one promote he new song wey dey come and make pipo forgive am for wetin he don cus with him mouth.
But that one nor still end mata as on Thursday nai NAPTIP confam for two pages letter say make he come dey office and if he nor come dem nor go take am easy with am.