Edo State House of Assembly don give summon to Natasha Osawaru wey be Innocent Idibia (2Baba) new wife, to come tok why she dey bring shame to di Assembly.
Osawaru, na lawmaker wey dey rep di pipo of Egor constituency for Edo State, and dem say she go face di House Ethics and Privileges Committee afta dem see her online dey get show down with 2Baba from one video for Daddy Freeze show and anoda one wey she dey blast her husband for London store.
On Tuesday as di House dey tok nai di Speaker Blessing Agbebaku say he nor like di way Osawaru just dey behave as she dey drag all of dem name for gutter online.
Di Speaker say pesin wey di make law suppose karey demsef with dignity and dem don give Osawaru one week to come tok why she dey behave anyhow for those videos.
