+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Ndume Give Presido Tinubu Anoda Gbasgbos

Di Senator wey dey rep Borno Senatorial District, Senator Ali Ndume don troway anoda gbasgbos for di govimet of Presido Tinubu again.

Dis time he say bad policies and changes wey nor dey make sense nai pipo wey dey position dey karey give Presido and now APC don tok dsm own.

Remember say APC bin don troway Ndume komot as Chief whip of Senate bifor dis new tok wey hin say di sufaness too much make di govimet do sumtin bifor tins bad pass as e be.

Wey di National Publicity Director of APC, Bala Ibrahim, come dey ansa Ndume on Sunday, he say make di senator karey any mata straight to Presido Tinubu instead of to come out dey come tok am outside.

Ibrahim say freedom dey to tok but nor be e mean say pesin go dey yarn opata for outside as any pesin fit change di word but dem as a part still dey look Ndume.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM