+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Nedu Don Komot From Honest Bunch Podcast, Deeone Dey Beg Nigerians To Epp Am

‎As tok don full everywhere about Nigerian radio personality, Chinedu Emmanuel, aka Nedu Wazobia, nai di man kukuma come down as host for di Honest Bunch Podcast.

‎All di wahala start afta Deeone go di podcast go tok say Martins Vincent Otse, VDM, dey run man to man tins but instead of VDM to face Deeone he turn am to Nedu say na him cus all di problem and go open Nedu secret of all di girls wey he don sleep with.

‎But for him Instagram handle on Friday, nai Nedu take post say he nor join di podcast again cus of he life, family and loved ones safety.

‎He say he dey happy for di time wey he dey di Honest Bunch Podcast, but as e be now di lie for him head just too much and he nor want make he head blow.

‎Nedu say na only wetin get meaning nai dem dey tok for di podcast but since di negative vibes don too much, make he nor go die bifor he time.

‎Even now sef, Deeone don dey cry for social media dey call celebrities, activists and pipo wey get mouth to come epp Nedu cus na him tok wetin he tok no be Nedu, say make dem nor allow Nedu die like Mohbad

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM