+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

NELFUND Say Student Loan Portal Go Open May 24

Federal Govimet don put final date for wen di Student Loan Application say na May 24, 2024, nai dem go start to dey apply for di portal according to di Managing Director, Mr Akintunde Sawyer of di Nigerian Education Loan Fund.

Na for statement on Thursday nite nai Nasir Ayitogo media lead of the Fund, take open up say di portal afta dem don finish everytin, e nor dey hard for student to check as only dem fit easily navigate aroung am to submit application.

For di months of April nai President Tinubu sign di bill come even make some adjustment to am cus where dem wan take get moni to fund di loan na from different sectors of di kontri.

Na cus of di loan nai make govimet create NELFUND wto handle all di loan wey pipo go ask for, grants, how dem go use share am and ways to take kolet di loan back from students.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM