+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

New Minimum Wage Go See Front For July, TUC President

Mind don dey high sag di new minimum wage go fit get eye to see road as Organized Labour don dey put eye sta by July ending all di tok go manifest.

Trade Union Congress (TUC), President, Comrade Festus Osifo, nai say di National Tripartite Committee wey organized labour and govimet dey don dey settle tok make President Tinubu sign di bill then karey am to National Assembly to stamp.

Na wey Kogi State Special Adviser on Labour Matter, Onuh Edoka, karey some of he pipo go visit for Abuja nai TUC president take say di cry of workers go soon reduce.

Usifo come still dey urge all di states for di kontri make dem start to dey put tins in place to pay di new minimum wage, cus nor be when dem don start states go dey say dem nor get moni, ad labour go make sure say everybodi comply.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM