Na almost 10 years nai Justin Trudeau sitdon for position as Prime Minister for Canada bifor he tok for January say seat don tire am, nai dem do election wey di new Prime Minister don come now, Mark Carney.
Carney don bin work as Manager for Canada Central Bank and England Central Bank bifor he go find place for politics and e come favour am, cus I’m Friday him and he cabinet go sitdon wella for leadership position.
Na from di Govinor general office on Wednesday nai dem take say so 59 years man go be prime minister afta he don win 86 percent of di vote wey pipo vote.
As e dey tok for di speech on Wednesday nai Carney say afta he don sitdon for di seat, he go follow US President Donald Trump tok make dem know way forward concerning di problem of 25 percent level wey US stake sama Canada and Canada too give dem own bomb.