+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Nigeria Dey Jump Enta CNG, Malaysia Dey Band Am

Some pipo for Nigeria don dey vex for di CNG initiative wey Federal Govimet bring afta dem komot fuel cus as e be naw, Govimet of Malaysian wey don dey do CNG since 1995 tok say dem dey stop am for July 2025.

Na di Transport Minister of Malaysia, Anthony Loke, nai tok for press meeting say afta pesin don use CNG for long time e nor go come good for pesin to use again as e for cus big harm.

He say di time wey CNG fit stay nor pass 15 years and afta then of pesin nor change am nai be say na disater go full everywhere.

Di Malaysia govimet promise say dem go bring epp to those wey get Natural Gas Moto but for Nigeria CNG just dey start and Federal Govimet say nai cheap pass moto wey dey use fuel.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM