+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Nigeria National Anthem Now Na ‘Nigeria We Hail Thee’

Senators don bin sitdon say dem wan resin make dem change di National anthem wey be ‘Arise O Compatriot’ to di old one cus e go epp make Nigeria dey togeda and dey tik of love.

Naso dem come debate about am, gree say na wetin di kontri need right now.

As President Bola Tinubu come go di joint meeting to follow di Senators and House of Rep members tok base on say today na one year anniversary for office, na there he come sign di bill to law to change di National anthem.

Na Speaker for di House, Godswill Akpabio nai tok say Presido don sign am and from now on na ‘Nigeria We Hail Thee’ nai go be di new anthem.

Dis old anthem na one oyibo woman wey be Lilian Jean Williams nai write am for Nigeria wey di kontri get independence bifor military come take over change am to ‘Arise O Compatriot’.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM