+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Nigeria Nor Get Defence Minister As Badaru Sack Hinsef

Alhaji Mohammed Badaru Abubakar wey be Nigeria Defence Minister don karey bag say he nor wan defend di kontri again.

Na for letter wey he write December 1, come send am to President Bola Tinubu, nai di Defence Minister say he dey sick so nai make am nor fit do di work again and na sharply he take dey stop di work.

Bifor Badaru sack he sef, President Tinubu don say Nigeria get national security emergency.

Bayo Onanuga say President Tinubu, nor vex for Badaru but accept di letter and thank am for di time wey he serve do kontri, but na dis same week anoda pesin go replace Badaru.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM