+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Nigerian Student Wan Break Ironing Record For 155 hour

Anoda Nigeria man don decide to write him name ontop Guinness World Record for di longest hour wey pesin iron clothes.

Jeremiah Abiola Fasipe, na student for UK and he don make am clear say from on di 1st of July to 6th of July 2024, he go iron clothes for 155-hour.

He say di resin wey make am dey wan do di challenge na during wey he dey learn tailor work 2018 for Kirikiri town for Lagos, that time na him dey iron all customer clothes. Na from there he mind come dey for ironing.

Jeremiah come still say dis challenge na to ginger pipo make dem push demsef beyond dem limit and to show how pesin fit endure anytin.

GWR don already approve di challenge na to wait for di main day wey go hapun for 350 Petre Street, Sheffield inside obodo UK.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM