+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

NIS Nor Do Bad To Increase Price Of Passport, FG

Pipo head go always remember August 29 wey Nigeria Immigration Service (NIS) tok say from September 1, 2025, pesin wey wan go do 32-page passport wey dey last for five years go now dey pay N100,000, while di one wey want 64-page passport for 10 years go pay N200,000.

‎As di mata drop, temperature go up as everybodi start to dey provoke bit Federal Govimet don say make pipo chilax as NIS get beta resin wey make dem karey price go up.

‎On Friday for X nai di Senior Special Assistant to President Bola Tinubu, Temitope Ajayi, say wetin NIS do nor bad as na to make di passport get beta quality cus even with di price wey dem put, Nigerians don already dey use back door pay pass like dat unto say dem want express.

‎Di explanation never calm anywhere as mouth still full di mata but NIS say Nigerians wey dey stay obodo abroad dem price to do passport still remain $150k and $230k.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM