Shock enta pipo wey dey stay for Udu LGA bodi afta Delta State Nigerian Medical Association (NMA), Warri Zone, go open one hospital wey dey hide sell children for Orhuwhorun Road.
On Tuesday, August 26 nai di Chairman of NMA Warri Zone, Dr. Djebah Bright, say dem get to know about di baby factory afta dem association waka for normal check to know which hospital be real it fake, na there dem come even see four small babies for di fake hospital.
Di name of di hospital na Blessed Gifted Hospital wey dey for nuba 17 Orhuwhorun Road, near Silver Link Hotel, and di dokitor wey get di place Udom Nyakno Reuben aka Gift Gab no be even dokitor.
Dem come arrest di dokitor and one nurse wey dey learn work for di place, as dem see her dey feed di four babies, take dem to Ovwian Police Station bifor dem shift dem to Police Force Headquarters for Asaba.
Dr. Bright say dem don karey di children go put for orphanage from for Asaba and dis period na no time for quack and dem nor go stop to catch fake dokitors.