+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

NNPCL Ogas Use 5 Private Jet Fly To Rwanda For Retreat

‎For some time now na only gbasgbos from probing nai Nigeria National Petroleum Company Limited (NNPCL) ogas dem dey face, from the one of how dem spen moni to change Warri refinery, Port Harcourt own and now anoda mata of travel wey dem do to Rwanda.

‎Now pressure don be like beans wey dey ontop pressure pot as new mata don come out say NNPCL hire 5 private jet take fly go executive retreat for Kigali di capital of Rwanda for two days event.

‎Pipo wey di jet karey na di senior ogas, board members and di oga kpatakpata, Bayo Ojulari.

‎Wetin insiders tok be say na one belong to Abdullahi Bashir Haske, nai get di ‎jet and na still owner of Etihad Oilfield Services.

‎That company na wetin NNPCL don put for black book cus dem price na die and di company sef EFCC dey investigate dem onto say dem dey own dem contactors.

‎Di tori come still get am say pipo come dey vex dey tell Ojulari make he stop all di plan but he nor hear he still rent di private jet.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM