Nigerian National Petroleum Company Limited, NNPCL, don say dem dey find pesin or pipo wey go epp take over and maintain Warri refinery wey di kontri build for 1978.
Na for X on Friday nai di company take bring out di information make everybodi know.
Dem come still say even di Kaduna petrochemical company still join dey look for private owners wey go epp maintain and take care of di refinery.