The Presidency don talk say dis past weekend, fire outbreak happen for outside the perimeter of Aso Rock, wen be Naija seat of power.
According to Garba Shehu, presidential otota, the matter play between the villa and the army barracks “towards Asokoro”.
He come talk say d report wen dey play say na for inside Aso rock gan gan nia d the fire outbreak for take happen no be true.
Wen Shehu come dey voice for one statement on Sunday, he come talk say na bush fire, but say dem don start investigation on top d matter.