+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

No bodi Go Tiff For Wike House – Police

With information wey dey waka upadan for social media say pipo wey dey protest for Rivers State, Port Harcourt, go Nyesom Wike house go tiff nor be true.

Na di Police Public Relations Officer, Grace Iringe-Koko, nai tok say notin like that hapun and she go still ask kwestun.

Aproko waka say protesters march from Choba to Ada-George road where Wike house dey come dey go scatter tins.

But even Prince Wiro, di National Coordinator of Center for Basic Rights Protection and Accountability Campaign, CBRPAC, say notin like that hapun as di pipo only karey flag, leaves dey for front of di house dey sing come waka pass.

He say make pipo nor dey tok wetin dem eye nor see and dem ear nor hear cus even police tanda gidigba for Wike property to guide am.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM