Pipo wey dey bring products, distributors, and even sellers nai dem don dey advise make dem stop to bring one particular brand of Nivea Roll-on with bar code 42299882 wey dem do for Germany, say e get wetin fit condemn human being life.
Na National Agency for Food and Drug Administration and Control, NAFDAC, nai say one 50ml batch of Nivea Black & White Invisible 48-hour Roll-on nor good at all for human being to use.
For notice wey di agency release on Thursday, nai say di product with batch nuba 93529610 nor dey good to use for African weather cus European Union Rapid Alert System for Dangerous non-food products in Brussels nai first give di update.
Naso NAFDAC start to kolet all di ones wey don already dey for market cus di Nivea product get 2-(4-tert-Butylbenzyl)
propionaldehyde, one kind chemical wey go fit make man and woman nor for born pikin, or make pikin wey pesin born get one kind bad problem then even cause burn or skin irritation for some pipo.