The Christian Association of Nigeria CAN don warn some Muslim leaders for the country say make dem no dey continue to dey promote violence and trouble so dat religious gbege no go burst out.
Na the General Seceto of CAN, Joseph Daramola nia give d warning for one statement wen he title ‘Muslims should stop stirring up religious crisis in Nigeria’.
Even as CAN dey tell the security agencies to caution and prevent any group of people when e be say their actions go fit lead to religious and social crises and violence for the country, the organisation come talk say e dey pain say for all over Naija, e get some actions wen some Islamic leaders dey take to provoke their Christian counterparts to anger.