As e don turn norm for final students to always dey celebrate their graduation, buy drinks and do party, Ebonyi State University Management don say that habit dem nor want an again for dem skool.
Na for statement wey di Registrar of di university, Jeremiah Nwamgbo, sign for Abakaliki nai dem take put am say dem don ban final year graduation celebration kpatakpata.
Dem say those celebration don cause many wahala for di skool sotay e dey disturb pipo wey dey learn and even cause security problem.
Di Vice-Chancellor of di university come join tell di Presido of Students Union Govimet to shout di ban wella so that any pesin wey dem punish nor go say e nor hear.