+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

No More SS3 Tranfer To Anoda Skool — FG

Tins nor go be same again for students wey dey plan to transfer go anoda skool wry dem dey SS3 as govimet don put everlasting ban for that road.

Weda na private or govimet skool dey mind wey di pesin wan change to e nor go work cus on Sunday nai di announcement come from di Federal Ministry of Education Director of Press and Public Relations, Folasade Boriowo, say as from 2026/2027 academic year that pattern of changing skool to go write exam for anoda skool nor go work.

Dem say di expo don too much for exam period, so pesin get mind say he wan change skool make he do am for SS1 or SS2, cus anytin SS3 na wotowoto eye dem go use follow am.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM