Presidency don come out to reject di video wey say pipo wey dey cook for di presidential villa kitchen try to poison President Bola Tinubu.
For di video di pesin wey dey tok say na top information nai dem get and naso police take grab di kitchen food posioner arrest am but dem nor wan make di news shout, make pipo nor too fear.
But on Sunday, Special Adviser to President Tinubu on Information and Strategy, Bayo Onanuga, for X say make pipo nor belive wetin di video tok as nor bodi try to posion Tinubu.
He say, “Nobodi arrest any Aso Rock kitchen staff. No Aso Rock kitchen staff try to poison President Tinubu. Abeg make una nor resin di fake news.”
