Ministry of Education say make pipo wey get skool, students and parents nor resin one history book wey be “Living History,” as govimet nor get any connection with di textbook.
Dis Living History textbook gt coma wey folow am cus dem say tims wey hapun for Igbo land nor dey inside, but on Monday, nai di Director of Press and Public Relations for Ministry of Education, Boriowo Folasade, come say FG govimet nor go just sit don approve that kind book make skools dey use.
Di education ministry say dem nor even use eye see di book and dem nor even submit am to National Educational Research and Development Council, wey be di body wey even suppose check any book bifor dem send am to skools to use.
Naso dem tell everybodi wey di mata concern make dem nor use anytin wey givinet nor approve for skools ans students.
