+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Nor Be We Increase Fuel Price, FG

Di new price of fuel wey don jump go N1,030 for Abuja N998 for Lagos don make pipo dey wonder where di kontri dey really dey drive to even as NLC dey ask Govimet and dem say their hand nor dey for di increase.

Federal Govimet on dem own don tom thru di mouth of di Minister of Information and National Orientation, say dem hand nor dey for fuel price as na NNPCL dey do am base on di gbege wey dey middle east nai make di price rise like ijegbu garri.

Mohammed Idris come say Govimet hand nor dey for dis new price mata as na NNPCL dey do am with Petroleum Industry Act, PIA, wey dey in ground

He come dey beg Nigerian make dem dey patient with NNPCL say price go soon come down, cus afta di subsidy wey dem remove, NNPC bin dey pay some kind moni but dem no come fit again cus of gbese.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM