On Sunday 21 September 2025 nai be World Cleanup Day and di Itsekiri Environmental Protection Initiative, IEPI nor allow di day pass without telling govimet to fix di Ugbuwangue and Nigerian Ports Authority, NPA New Port road along NPA Expressway in Warri.
Di group karey protest go di road as dem dey complain about how di bad road don cus more harm to dem especially di one wey hapun on 15 of September wey motor wey dey dodge di bad spot wey water dey go jam Miss Agirly Obinini die.
Wey dem dey do di protest nai di Project Committee Chairman of IEPI, Bibi Oye come say cleanup nor be only to pick dirty from road but to tok about bad road palava.
Nai di group come say make Delta State Govimet, Federal Ministry of Works, Federal Roads Maintenance Agency (FERMA) and National Environmental Standards and Regulations Enforcement Agency (NESREA) quick come do di road and do gutter so that di road go last.