+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Obaseki Dey Fear EFCC Nai Make Am Run, Edo Govinor-elect

As di 8 years wey Govinor Godwin Obaseki time die office go finish tomorrow, rumour dey fly say he don run komot from Nigeria make dem nor catch am.

Na di new Govinor, Monday Okpebholo wey go take over on Tuesday nai say fear don enta Obaseki heart cus of all di yeye tins wey he dey do for di state since 2016.

Tuesday November 12, nai Okpebholo go sitdon as Govinor of Edo State but he don dey hit am since say wey Obaseki komot from office, he door gate nor go far from where Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).

Di statement wey di new Govinor release thru him aide say na since on Friday nai dem nor see Obaseki again for Govimet haux and even porchu all di workers wey dey with am.

But even with di alarm wey Okpebholo blow, sources outside say nor be true as dem see Obaseki for Lagos on Sunday nite.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM