Di bodi wey dey involved for all di plane wey dey fly for di kontri , Nigerian Civil Aviation Authority (NCAA) don tell all di pipo wey get airline make dem tell dem passengers to always off dem phone wey plane dey wan komot from ground and any time e wan land.
Na wey pipo wey get areoplane, Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN), Nigerian Airspace Management Agency (NAMA), Federal Ministry of Aviation and Aerospace Development, National Assembly, and oda pipo wey dem hand strong for flying mata do meeting for Abuja nai dem take say dem nor go accept any passenger wey behave like Emmanson or KW1 again.
Di Director General of NCAA, Captain Chris Najomo, really draw ear for di mata say dem nor wan hear or see flight mode but make phone off and all di airline pipo make dem make di changes come show NCAA for approval.
All di tin wey dem tok about dey point to di way Comfort behave for Ibom Airplane, now enough training go dey for airport workers and di mata go dey very serious cus dem don call pipo wey involve for di airport saga to come tok wetin really hapun that Sunday from Uyo to Lagos.