The people for community of Ugeh-Gbene for Kokodiagbene town, Gbaramatu Kingdom wen dey for Warri South-West Local Government Area wen oil spillage don affect bad bad don talk say dem no like d way wen Chevron Nigeria Limited take dey handle d mattee of the oil spillage from their Utonana flow station when happen since 18 February 2021.
For one letter wen d Chairmo of the community, Engr. Johnbull Tortor; their Seceto Engr. Gabriel Ukuli sign, the people come dey complain about the way wen dis matter don take affect their livelihood and health.
Them come still complain about d I don’t care attitude of Chevron Nigeria Limited towards wetin dem dey pass thru.
Other communities wen d matter still affect too alongside Ugeh-Gbene include Ede-uba,, Igho-suogbene, Jones Creek and some others for Gbaramatu Kingdom and like dis Chevron Nigeria Limited neva gree compensate the people.