Seven days ultimatum wey Okuama community give say make govimet gree dem leaders and di President General of di community deadi bodi wey die for military hand, anoda one don hapun again.
E never tay wey Okuama cry come out say Pa James Oghoroko die, Dennis Okugbaye wey be di community treasurer don still die for military hand.
No be small fear deg di pipo bodi cus na six days nai back nai PG die and now treasurer dey follow, dem say make President Bola Tinubu and Army ready to finish all di village pipo as dem go really go block di water.
As di 81 years man die na di son wey be Pastor Akpos Okugbaye, nai annonce am on Tuesday say he papa don die and still others dey cry for military cell.