+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Omo-Agege Don Tok About Govinor Sheriff Oborevwori Wey Join APC Canoe

With wetin pipo dey believe say go hapun afta Delta State Govinor, Sheriff Oborevwori komot from PDP enta APC, Ovie Omo-Agege wey be di opposition bifor don tok how di mata be for he end.

‎D foma Deputy Senate President, on Sunday go tok about di mata for statement wey dem release on Sunday say APC for national level and state dey work to make sure say dem safe guard Delta.

‎Nai Omo-Agege come tell all di state stakeholders make dem welcome peace so that Delta State and Nigeria fit see progress and move forward.

‎He come tell all di APC ward and local govimet executives say make dem use spirit of brotherhood take gada for reception rally wey dem go do today, Monday, for Asaba to welcome Govinor Sheriff Oborevwori, foma Govinor Ifeayin Okowa and plenty odas wey leave PDP to APC.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM